Una must offa seven lamb wey bi one year, one small melu and two rams, join di bread. Dem go bi burnt ofrin to God with dia korn and drink ofrin and God like dis gift.
Una go still give di wine ofrin with each sakrifice: two kwota of wine for each melu, three kwota for di ram and one kwota for each lamb. Make una dey do dis sakrifice for di first day for evry mont
Make una give dis plus di normal burnt ofrin for di first day for di mont with en korn ofrin; di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin. Dis food ofrin get betta smell wey God like well-well.