Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 29:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 “ ‘Make una gada woship God for di fifteent day for di sevent mont. Una go do dis to take honor God for seven days and una nor go do any work.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 29:12
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Jeroboam still dey do one feast for di fifteent day for evry eight mont, just like di feast for Judah. E make sakrifice for di gold melu on-top di altar wey e make for Bethel kon put priest for di woship place wey e build.


Dem celebrate Shelta Festival akordin to wetin dey di law and evriday, dem dey offa di sakrifice wey dem suppose offa


Dem si sey, Moses rite for God Law sey, make Israel pipol stay for shelta wen ever dem dey do di feast for di sevent mont.


From di first day wey di festival start go rish di end, dem dey read one-one part from God law evriday. Dem celebrate for seven days kon finish di festival for di eight day, just as dem rite am for di law.


Make una still celebrate Harvest Feast wey bi di first fruit from evritin wey una plant for una land. Una go still celebrate Tanksgivin Feast wey bi di Shelta Feast wen di year end and for dis time, una go don gada all una harvest from di farm.


Una must keep di Week Feast wen una don bigin harvest di first fruit from una farm and di Tanksgivin Feast wen di year don end.


For di Festival wey go start for di Fifteent day for di seven mont, di prince go offa di same sakrifice for sin for dat seven days. E go burn di same ofrin kon give di same korn and olive oil.”


For di first day, una go gada woship and una nor go do any work.


“ ‘For di first day for di sevent mont, una go gada woship mi. Una must nor do any work, bikos dat na di day wey dem go blow trumpet for una.


For di first day, una go give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: una go give thirteen yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay.


“ ‘For di eight day, make una gada woship and nor do any work.


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ