Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 28:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Dis na di evriday burnt ofrin wey dem go first give for Mount Sinai as dia food ofrin, bikos na betta ofrin e bi to God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 28:6
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I dey ready to build one temple to honor di Oga my God and to dedikate am gi-am. I go burn betta incense for am; offa bread and burnt sakrifice evry morning and evening and for Sabat Day too. I go do di same tin for new moon festival and evry oda tin wey di Oga my God tok. Dis na wetin Israel pipol go dey do.


Di king give some of en animals as burnt sakrifice, with di morning and evening burnt sakrifice and di sakrifice wey dem dey burn for Sabat Day, New Moon and any oda time wey dem rite for God Law Book.


Dem celebrate Shelta Festival akordin to wetin dey di law and evriday, dem dey offa di sakrifice wey dem suppose offa


I nor dey komplain about una sakrifice or di burnt ofrin wey una always dey offa.


Moses enter inside di kloud wen e klimb di mountin and e stay der for forty days and forty nites.


Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.


Una go still dey give mi five pound of flower evry morning with one kwota of olive oil wey dem mix with flower. Una must kontinue to give dis ofrin forever.


Evry morning, una go offa di sheep pikin, di flower and di olive oil give God as ofrin forever.”


Dis na di kommand wey God give Moses for Mount Sinai and na for Israel pipol.


“Make yu kommand Aaron and en sons sey, ‘Dis na di burnt ofrin law. Dem go leave di burnt ofrin on-top di altar till day break and di fire go kontinue to dey burn.


Israel pipol, I nor ask una for sakrifice and ofrin for doz forty years wey I lead una pass desert.


each one with di korn ofrin wey bi one kilogram for flower, wey dem mix with one lita of di best olive oil.


For di wine ofrin with di first lamb, make una pour one lita for di altar.


But even if dem take mi offa sakrifice for una, I go dey happy,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ