Priest Jehoiada put di priest and Levi pipol make dem dey work for di temple. E sey make dem do di duty wey King David give dem and burn di sakrifice wey dem give God with joy kon dey play music, just as dem rite am for Moses Law.
Di king give some of en animals as burnt sakrifice, with di morning and evening burnt sakrifice and di sakrifice wey dem dey burn for Sabat Day, New Moon and any oda time wey dem rite for God Law Book.
and Jeshua wey Jehozadak born, en fellow priests, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin and en family membas kon build di Oga wey bi Israel God altar back, so dat dem go fit dey burn sakrifice for der akordin to wetin dem rite for God savant, Moses Law.
Na en work to bring di animal wey dem go burn, di korn ofrin for di New Moon Festival, di Sabat Day and di oda festivals. Na en go provide di ofrin for sins; di korn ofrins, di full animal wey dem go burn as ofrin and di fellowship ofrin, so dat God go forgive Israel pipol dia sins.”
“For di eight day, e go bring two man lamb and one woman own wey bi one year and dem must dey okay and if dem divide flower bag into ten, e go bring three part wey dem mix with olive oil. If dem divide one lita for olive oil into ten, e go bring three part kom.
Make una give burnt ofrin, di kind smell wey God like well-well, dat is: two yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.