24 Like dis too, for seven days, make una give God food ofrin, di smell wey E dey like well-well. Make una give all dis ones, plus di evriday burnt and wine ofrin.
Dis na di tin wey yu go offa give mi with di first lamb: yu go offa am with di Tabanako efah wey get fine flower wey dem mix with one kwota of oil wey dem press komot from some olives and one kwota of wine as drink ofrin.
For each of di seven days for di festival, e go sakrifice seven ram wey dey okay kon burn dem give God. Evriday, e go still sakrifice one goat as ofrin for sins.