Dis na di tin wey yu go offa give mi with di first lamb: yu go offa am with di Tabanako efah wey get fine flower wey dem mix with one kwota of oil wey dem press komot from some olives and one kwota of wine as drink ofrin.
Una go still give di wine ofrin with each sakrifice: two kwota of wine for each melu, three kwota for di ram and one kwota for each lamb. Make una dey do dis sakrifice for di first day for evry mont