Di strenjas wey dey among una and di ones wey born dia shidren for here, go still kollect dia own share wen una dey divide di land. Una go trit dem as una dey trit Israel pipol and dem go trow dice for each land wey go bi any tribe for Israel own.
Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.
sey, “God don kommand una make una trow dice take share di land give Israel pipol. E still kommand una make una give Zelofehad awa broda propaty to en dotas.
Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own. Den di land kon get peace and di war kon stop.