11 “Finehas wey Eleazar born, wey bi Aaron di priest grand-pikin don remove my vexnashon from Israel pipol, wen e do dat tin wey e do and naim make mi nor distroy dem wen I dey vex.
den e beri Saul and Jonatan bones for Saul papa, Kish, grave for Zela wey dey Benjamin aria and di pipol do evritin wey di king kommand. Afta evritin wey dem do, God kon ansa Israel pipol prayer.
Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
“Anybody wey allow en animals wey dey chop grass for field go chop wetin anoda man plant for en farm, e must pay back with wetin good pass for en own farm.
Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.
So God sey, “Una must get patient as una dey wait for mi. For di day wen I go attack kon karry all una propaty, I don decide sey, I go gada nashons and kingdoms togeda kon pour my vexnashon on dem. Bikos my vexnashon go full di whole world.
Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”
Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.
Joshua kon warn di pipol, “Una nor go fit dey woship God as E wont, bikos E dey holy. E dey jealous and E nor go forgive una if una turn from am kon sin.