28 So Balak take Balaam go on-top Peor for di wildaness.
Den awa grand-grand papa join bigin woship Baal for Peor, dem even chop sakrifice wey dem offa give dead body!
Dem still travel from Bamot go di valley wey dey Moab kountry, on-top Pisgah wey face di wildaness.
Balak tell Balaam, “Abeg make yu kom; I go take yu go anoda place. May bi God go allow yu curse dem from der.”
Den Balaam tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi kon bring seven melu and seven ram.”
Wen Balaam si sey God wont make e bless Israel, e nor kon go meet God as before, but e turn waka go near di wildaness.