23 Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’
Si as yor favor great rish; di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu. Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem and Yu dey bless dem for evribody front.
Babilon king go stand near di sign post for where di road for start. E go shake di arrow, ask en juju kweshon kon shake di animal liver wey dem sakrifice, so dat e go know where e dey go.
“Naw, awa God, na Yu take yor pipol komot from Egypt with yor mighty pawa kon make name for yorsef wey dem nor fit forget forever. Wi don sin and wi dey bihave like wiked pipol.
Wen Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, e kon sey, “Evry kingdom wey dey fight with ensef go skata and know town or family wey dey fight demsef, go fit stand.
Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.
Evribody wey dey for der kon kwayet dey hear wetin Banabas and Paul dey tok and dem tell dem about di mirakles and wonders wey God use dem do among Gentile pipol.