15 Balaam kon tell am, “Make yu stand near yor burnt ofrin and I go-go pray to God.”
Balaam ansa dem, “Make una stay here dis nite and I go tell una anytin wey God tell mi.” So di eldas for Moab kon stay with Balaam.
So Balak take Balaam go Zofim field, on-top Pisgah, where e for build seven altar kon give one melu and one ram for each of dem.
God kom meet and tell Balaam, “Make yu go back go meet Balak kon tell am wetin I tell yu.”
Balaam tell Balak, “Make yu stand for here near yor burnt ofrin and I go-go pray and anytin wey God show mi, I go tell yu.” So only Balaam kon go on-top di hill.
I nor gri listin to Balaam; instead e dey tok good tins about una and I save una from en pawa.