29 Balaam ansa di donkey, “Na bikos yu make mi look like fool: if to sey I get swod for my hand, I for don kill yu naw.”
Laban kon sey, “I gri! Make e bi as yu tok.”
Raitious pipol dey kare for dia animals, but wiked pipol dey trit dia own anyhow.
Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
Di donkey ansa, “Nor bi mi bi di donkey wey yu dey ride since kon rish today? I don ever trit yu like dis?” Den Balaam ansa, “No.”
Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and na dis tins dey make dem kill; sleep with who dem nor marry; tif; lie and judge pesin for en back.