26 God angel go front kon stand for one small place, where road nor dey to turn go rite or go left.
My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.
But I go fence and block una mama with shuku-shuku, so dat e nor go waka go anywhere.
Wen di donkey si God angel, e waka near di wall kon press Balaam leg against am. Den Balaam beat am again.
Wen di donkey si God angel again, e kon lie down for groun. Den Balaam vex kon beat di am with en stik.