13 So Balaam get up for morning and e tell di prince dem wey Balak send sey, “Make una go una land, bikos God sey make I nor follow una.”
But God tell Balaam, “Make yu nor follow dem go and make yu nor curse di pipol, bikos I don bless dem.”
So di prince dem go back kon tell Balak sey, “Balaam nor gri follow us kom.”
But di Oga una God nor gri listin to Balaam. Di curse wey Balaam suppose curse una, e turn am to blessing bikos di Oga una God love una.