Filistia pipol, di kane wey dem take flog una don break, but make dat one nor make una dey happy. If one snake die, di one wey bad pass go take-ova, bikos na dragon go fly kom out from di snake egg.
Dis message na about di animals for Negev: For der, di pipol pak dia propaty and money on-top donkey kon travel pass one land wey wahala and trobol full; where lions, snake and oda wiked animals dey stay. Dem travel go meet pipol wey nor go fit help dem.