Di land don dry and nor-tin dey inside again. Lebanon forest don dry finish; Sharon valley bi like desert naw and di trees for Bashan and Karmel mountin don dry finish.
Samaria wimen, una bi fat melu for Bashan! Una dey ponish pipol wey nor strong, wey dey poor and dey opress doz wey dey hongry, den una go tell una husband, “Give us more wine make wi drink.”
So Moses give Gad, Reuben and half for Josef first-born Manasseh tribe, all di aria wey bi Amor king, Sihon own and e still give dem king Og for Bashan own, plus di towns and kountries wey dey round dem.
E feed dem with milk from di animals and with di fats wey dey lamb body. E give dem betta ram and goat form Bashan, plus fine-fine food. Una don drink di wine wey sweet pass wey dem make from grape.
And all King Og aria for Bashan, wey dey rule Ashtarot and Edrei (wey dey among di remainin pipol for Refah), go bi dia own too. Moses win dem kon take dia land.
and di ones wey E do to di two Amor pipol king for di oda side for Jordan River and dem bi King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan wey dey Ashtarot.