Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 21:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Wi don ova pawa dem; from Heshbon go rish Dibon and all dia pipol don die finish. Wi don skata dem go rish Nofah wey dey near Medeba.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 21:30
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Hunta go attack am, dem go shot and oppoz am.


Den dem shot arrow from di wall kon kill Uriaya and some of yor ofisas.”


Di 32,000 shariot wey dem hire and Maaka sojas kon kamp near Medeba. All Ammon pipol ready kom from dia town to fight.


E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash, dem kon dey konfuse more-more.


Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.


Na blood full Demon river! God sey, “I go kause more trobol for Dimon town. One lion go kom attack and kill Moab pipol wey dey won eskape and di remainin pipol wey dey di land.”


Yu wey dey stay for Dibon, kom down from yor place where honor dey kon sidan for san-san; bikos di pesin wey distroy Moab and skata en strong-strong buildings, go distroy una too.


So Israel pipol kon dey stay for Amor pipol land.


“Atarot, Dibon, Jazer, Nimrah, Heshbon, Elealeh, Sebam, Nebo and Beon,


Gad pipol kon ribuild Dibon, Atarot, Aroer,


Heshbon and all di towns wey dey near am; plus Dibon, Bamot Baal, Bet-Baal-Meon,


Dia own aria go start from Aroer (wey dey near Arnon Valley), plus di town wey dey di valley centre; evriwhere for Medeba go rish Dibon


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ