Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 21:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 Moab pipol, curse dey una head. Kemosh pipol, una don skata! Una make una sons dey run anyhow and una dotas don turn King Sihon for Amor, prisonas.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 21:29
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go do dis tin, bikos Solomon rijet mi kon bigin woship oda gods. E dey woship Astarte wey bi Sidon juju; Kemosh wey bi Moab pipol god and Milkom, wey Ammon pipol dey serve. Solomon nor obey mi; e dey do bad tins and e nor keep my laws and kommand, just as David en papa keep am.


For di east side for Jerusalem hill, e build where dem for dey woship Kemosh, wey bi Moab pipol yeye god and Milkom, wey bi Ammon pipol god.


Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom.


My heart dey kry for Moab pipol, bikos di pipol don run go Zoar, Eglat and Shelishiyah town. Some even dey kry as dem dey go Luhit, while odas eskape go Horonaim town.


Moab wimen dey wait for Arnon River front; dem dey waka up-and-down like birds wey dem drive komot from en house.


Den, just as Israel pipol shame for dia god for Bethel, na so too Moab pipol go shame for Kemosh wey bi dia god.


Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.


Curse dey Moab land! Di pipol wey dey woship Kemosh don skata and di enemies don karry dia shidren go as prisonas.


Moab! Yu trust yor pawa and di many money wey yu get, but naw, yu go die and strenjas go karry Kemosh wey bi yor god, en prince and priests, go anoda land.


‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.


Yu fit take anytin wey Kemosh yor god give yu, but wi go take all di land wey di Oga awa God give us.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ