Yor neck fine just like ivory towa and yor eyes bi like Heshbon Pool wey dey shine near Bat-Rabbim Gate. Yor nose fine like Lebanon towa wey face Damaskus.
Pipol nor go praiz Moab again. Enemies don seize Heshbon land kon plan as dem go take distroy Moab town. Dem go distroy Madmen town too and na wiked sojas go mash kom skata am.
Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.
For three hundred years naw, Israel pipol dey stay for Heshbon and di towns wey dey near am; Aroer and di towns wey dey near am and di oda town wey dey Arnon! Why yu nor kom klaim di land, dat time?