Yor neck fine just like ivory towa and yor eyes bi like Heshbon Pool wey dey shine near Bat-Rabbim Gate. Yor nose fine like Lebanon towa wey face Damaskus.
Pipol nor go praiz Moab again. Enemies don seize Heshbon land kon plan as dem go take distroy Moab town. Dem go distroy Madmen town too and na wiked sojas go mash kom skata am.
Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.
“Yor sista and en pikin dey karry body up, bikos dem get enough to chop and dem dey stay for peace, but dem nor gri kare for poor pipol and doz wey nor get to chop.
Before-before, na Hor pipol dey stay for Seir, but Esau shidren-shidren drive and distroy dem, den kon stay der, just as Israel pipol do to di land wey dem take and na God give dem dis land.)”
“ ‘Den I kon bring una kom Amor pipol land wey dey east for Jordan River. Dem fight with una, but I make una win dem; una kollect dia land and I distroy dem finish for una front.
For three hundred years naw, Israel pipol dey stay for Heshbon and di towns wey dey near am; Aroer and di towns wey dey near am and di oda town wey dey Arnon! Why yu nor kom klaim di land, dat time?