24 But Israel pipol kill dia enemy well-well kon take di land from Arnon River for nort go rish Jabbok and Ammon side, but Ammon sojas bin guide dia aria well-well.
I distroy Amor pipol, bikos of my pipol; men wey tall like cedar tree and get pawa like strong tree. I distroy di fruit wey dey dia tree kon skata di rut for groun.
and as dem dey kamp for di valley near Bet-Peor wey dey east for Jordan River. (Amor pipol wey dia king bi Sihon wey bin rule form Heshbon, na dem get dis place before. But Moses and Israel pipol kom from Egypt kon distroy di king and en pipol.
And all King Og aria for Bashan, wey dey rule Ashtarot and Edrei (wey dey among di remainin pipol for Refah), go bi dia own too. Moses win dem kon take dia land.
“ ‘Den I kon bring una kom Amor pipol land wey dey east for Jordan River. Dem fight with una, but I make una win dem; una kollect dia land and I distroy dem finish for una front.
and di ones wey E do to di two Amor pipol king for di oda side for Jordan River and dem bi King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan wey dey Ashtarot.
Ammon king ansa, “Na bikos Israel pipol take my land, wen dem dey kom out from Egypt. Dem take my land wey start from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and Jordan River for west. So make una give mi back, so dat peace go dey.”
Na dis make us ask sey, ‘Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?’ ” Den dem kon notis sey, Jabesh nor follow dem gada for Mizpa.