Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.
and as dem dey kamp for di valley near Bet-Peor wey dey east for Jordan River. (Amor pipol wey dia king bi Sihon wey bin rule form Heshbon, na dem get dis place before. But Moses and Israel pipol kom from Egypt kon distroy di king and en pipol.
Bikos wi hear as God dry di Red Sea for una wen una komot from Egypt and how una handle di two Amor kings wey bi Sihon and Og, for di oda side for Jordan River.
“ ‘Den I kon bring una kom Amor pipol land wey dey east for Jordan River. Dem fight with una, but I make una win dem; una kollect dia land and I distroy dem finish for una front.