20 Dem still travel from Bamot go di valley wey dey Moab kountry, on-top Pisgah wey face di wildaness.
from Mattanah to Nahaliel and from Nahaliel to Bamot.
Den, Israel pipol send messenja go meet King Sihon wey dey rule Amor sey,
Israel pipol kon travel go Moab for Jordan River for di oda side for Jeriko.
So Balak take Balaam go Zofim field, on-top Pisgah, where e for build seven altar kon give one melu and one ram for each of dem.
So Balak take Balaam go on-top Peor for di wildaness.
Dis na doz wey Moses and Eleazar di priest kount among Israel pipol for Moab near Jordan River wey face Jeriko.
So, wen Israel pipol dey for Moab land wey dey Jordan River, na der Moses for tell dem dis law:
But klimb go Pisgah and make yu look di east, nort, sout and west well-well, bikos I nor go let yu cross Jordan River.
Den Moses komot from Moab Wildaness kon go Mount Nebo until e rish on-top Pisgah mountin, opposite Jeriko. God show am all di land from Gilead go rish Dan,
Israel pipol still win all di wotaside for Jordan River east go rish di sout for di Deat Sea, under Pisgah aria.)