Una must gada all di dirty for der kon put am for di street centre, den burn di town rish groun as ofrin to di Oga una God. Una must distroy di town forever and make nobody build am again.
Di town plus evritin wey dey inside go bi God own, escept Rahab wey bi ashawo and evribody wey dey with am for inside en house, bikos e hide awa pipol wey go spy di town.
For dat time, Joshua kon swear sey: “Anybody wey sey e won build Jeriko town again, God go kondemn am. “E first boy pikin go die as e stay to build am and en last boy pikin go die wen e dey put di gate!”
So e kon promise God sey, “My papa, if Yu go sorry and remember mi, yor savant, den give mi one boy pikin, I go dedikate am give Yu as long as e dey for dis life and dem nor go ever kut en hair.”