17 Den Israel pipol kon sing dis song: “Make dis well kom up kon sing to God!
Make wi sing to am. Yes! Make wi sing to am. Make wi tink about all di wonderful tins wey E do!
So en pipol kon bilive en promise and dem kon dey sing and praiz am.
Make wi sing give God, bikos of di great tins wey E don do and make di whole world hear di news.
Di well wey di princess dig, wey di leaders open with dia septa and staff.” Dem travel from di wildaness go Mattanah;
If anybody dey sofa among una, make e pray. If anybody dey happy among una, make e sing dey praiz God.
For dat day, Deborah and Barak, Abinoam pikin, sing dis song: