9 So Moses take di stik from God present, just as God kommand am.
But make yu yorsef raiz yor stik kon take am divide di Red Sea, so dat Israel pipol go waka pass for dry groun.
Den Moses take en wife and pikin, karry dem put on-top donkey kon go Egypt. Moses hold di stik wey God gi-am for en hand.
Den God tell Moses, “Make yu bring Aaron stik kom back before di Testimony Box kon keep am as sign for sturbon pipol, so dat dia komplain go stop and dem nor go die.”