28 Den Moses remove Aaron priest klot kon wear am for Eleazar. Aaron die on-top di mountin, den Moses and Eleazar kon kom back.
David kommand all di leaders for Israel make dem help Solomon.
Anytin Israel pipol give God as dia peace ofrin, go bi Aaron and en sons share and nobody go shange dis law.
Aaron marry Elisheba wey bi Amminadab dota and Nahshon sista. Di woman born Nadab, Abihu, Eleazar and Itama for Aaron.
For di first mont, di whole kommunity for Israel go Zin Wildaness kon stay for Kadesh. For der, Miriam die and dem kon beri am.
Den remove Aaron priest klot kon wear am for Eleazar, bikos Aaron go die for der.”
Moses do wetin God kommand am. Dem kon go Mount Hor for di whole kommunity present.
Wen yu don si am, yu go die, just as yor broda Aaron take die.
Dem travel from Hashmonah go Moserot
For dat time, Israel pipol travel from Beerot Bene Jaakan go Mosera. Aaron die for der and dem beri am and en pikin Eleazar kon take-ova as priest.
So Moses wey bi God savant kon die for Moab land, just as God bin tok.
Naw, Nun pikin, Joshua get wisdom well-well, bikos Moses don pray for am. So Israel pipol dey obey Joshua and dey do God kommand wey E give dem thru Moses.
Eleazar wey bi Aaron pikin kon die too and dem beri am for Gibeah for di hill kountry for Efraim, where en pikin Finehas for get land.
I go try do evritin wey I fit do, so dat afta I don go, una go fit tok about dis tins.