Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 20:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Moses kon send message from Kadesh go give Edom king sey: “Di message na from yor broda Israel: Yu know all di sofa wey wi dey sofa,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 20:14
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and Oga God kon tell am, “Na two nashons dey yor belle and two pipol go kom out from inside yu. One go dey strong pass di oda one and di senior one, go serve di yonga one.”


Di first one kom out, evriwhere for en body red and hair full am, so dem kon koll am Esau.


Wen en broda kom out, e hold Esau leg, so dem kon koll am Jakob. Isaak na sixty years wen Rebekah born dem.


Den Jakob ask am, “Abeg make yu tell mi yor name.” But di man sey, “Why yu dey ask for my name?” So e kon bless am.


Moses tell en wife papa evritin wey God do to Fero and Egypt pipol, bikos of Israel pipol; di tins wey dem sofa for road and how God take save dem.


God sey, “Edom pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem kill Israel pipol wey bi dia own brodas and dem nor sorry for dem at-all. Dem vex kill dem anyhow and dem nor dey taya.


God sey, “I don show how I love una.” But una dey ask, “How Yu take show us love?” God kon ansa dem, “Esau and Jakob na brodas, but I choose una grand-papa, Jakob


Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land.


how awa grand-grand papa go Egypt where wi stay for many years. How Egypt pipol ponish us and awa grand-grand papa well-well.


So di whole kommunity for Israel komot from Kadesh go Mount Hor.


Make una nor hate Edom or Egypt pipol, bikos Edom pipol na una brodas and una stay as strenjas for Egypt.


Bikos wi hear as God dry di Red Sea for una wen una komot from Egypt and how una handle di two Amor kings wey bi Sihon and Og, for di oda side for Jordan River.


kon tell dem, “I know sey God go give una dis town. Wi dey fear una well-well and evribody wey dey stay di town dey shake bikos of una.


and di ones wey E do to di two Amor pipol king for di oda side for Jordan River and dem bi King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan wey dey Ashtarot.


Dem ansa, “Where yor savants from kom, far well-well and wi dey respet God, bikos wi don hear of all di tins wey E do for una for Egypt


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ