Anytin wey dem fall put wen dem die go dey unklean; weda na wood, klot, leda or sak. Doz tins nor dey yuzful again. Even wen dem deep am for wota, e go still dey unklean till evening.
If anybody chop any part for di animal, e must wosh en klot, but e nor go still dey klean till evening. Anybody wey karry di dead body must wosh en klot, but e go dey unklean till evening.
Di man wey gada di ashes must wosh en klot, but e go dey unklean till evening. Dis law na forever both for Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem.
For di third and sevent day, di pesin wey dey klean go sprinkol di wota for di unklean pesin body. For di sevent day, e go santify di man den di man go wosh en klot kon baf, den e go dey klean for evening.