All of una wey dey karry di temple tins, make una know sey God go save una from Babilon. So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid; make una make unasef holy, so dat una nor go die.
Nobody from Aaron family wey get diziz or dey discharge go chop di holy ofrin until e don dey holy. Pesin wey tosh anytin wey nor klean, bikos di tin tosh pesin wey don die; man wey dey discharge;
“ ‘Or if yu tosh anytin wey nor dey klean and yu nor know; sometin like dirty animal wey don die. Wen yu kon know wetin yu do, yu must show sey yu nor dey klean again and yu don sin.
Den Haggai ask again, “Wot of pesin wey dirty bikos e tosh dead body; if e tosh any of dis food, dat mean sey di food dem don dirty too?” Di priests ansa, “Yes!”
“Naw all of una wey don kill pesin or wey tosh dead body go stay outside di kamp for seven days and for di third and sevent day, make una and di wimen wey una katch klean unasef.
“Go kommand Israel pipol sey, ‘Dis na di pipol wey una go remove from di kamp: pipol wey get diziz for skin, doz wey dey discharge and evribody wey nor dey klean, bikos e go tosh dead body.
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘If any of una or una shidren nor dey klean, bikos e go tosh dead body or e waka go far place, but e still wont keep di Passova,
Di next day, Paul take di men and afta e don join dem do wetin Moses Law tok, e go di temple kon sey, dem don obey di law and dem ready to offa di sakrifice.
wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.