Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 18:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 And una nor go kommit any sin, since na di best part una give. Una must dey kareful, so dat una nor go trit di holy tins wey Israel pipol get, anyhow, bikos if una do am, una go die.’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 18:32
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Aaron and en sons must wear am anytime dem enter di tent where dem for dey do meetin or wen dem dey go serve for di Most Holy Place for di altar, so dat dem nor go die, bikos of any sin. Dis kommandment na for Aaron and en shidren-shidren forever.”


Anybody wey chop am go dey guilty, bikos e trit wetin dey holy wey dem give to God like ordinary tin and e nor go dey among my pipol again.


“Make yu tell Aaron and en sons sey make dem nor disgrace my name wey dey holy, but make dem trit di holy ofrin wey Israel pipol offa give mi with respet. Na mi bi God.


Dis na how una nor take dey respet mi: una dey offa yuzles food for my altar, yet una still dey ask, ‘How wi nor take dey honor yor name?’ I go tell una. Una sakrifice show sey una nor dey respet my altar at-all.


Di oda Israel pipol nor go kom near di tent where dem for dey do meetin again, or dem go bear dia sin and dem go die.


Una fit chop am for anywhere; both una and una family, bikos na una salari for una work for di tent where dem for dey do meetin, bi dat.


Bikos of dis, anybody wey chop di bread or drink di wine anyhow wey e like, dat pesin don sin against Christ body and en blood.


But if una nor undastand sey na una bi Christ body, una don already kondemn unasef with di way wey una dey chop and drink from di cup.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ