27 Den God go kollect una special ofrin as E take kollect farmer own for new korn and wine.
Wen dem rish Atad aria for di oda side for Jordan River, dem mourn and kry for der well-well. Na for der Josef for mourn seven days for en papa.
Di king ansa, “No! If God nor help una, na how I won take help una? I fit give una korn wen korn nor dey? Abi I fit give una wine wey I nor get?”
Una go give kake from una first flower wey una grind as special ofrin, just as una do for di first korn wey una grind.
“Make yu go tell Levi pipol sey: ‘Wen una don kollect Israel pipol tithes wey God don give una as una own, una must divide am into ten kon give one part as special ofrin to God.
God special ofrin and tithes wey una kollect from Israel pipol, una go give dem to Priest Aaron.
“So make yu Moses tell dem, ‘Wen una don give di best, una fit keep di rest, just as farmer dey keep wetin remain afta e don give en ofrin.
Make una give dem betta gift with happiness from una animal and from una wine. Make una give some of di blessing wey God give una.