Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 18:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 All di special ofrin for di tins wey dey holy wey Israel pipol give to God, I don give dem to yu and yor shidren forever. E go bi salt kovenant forever to God and na for yu and yor shidren-shidren.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 18:19
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

(Di money wey dem kollect, plus di ripair and sin ofrins, dem nor bring dem kom God Temple, bikos na di priests own.)


Una nor know sey di oga wey bi Israel God get agriment with David family sey, dem go rule Israel forever?


E give orda sey make di pipol for Jerusalem bring dia own part wey dem go share give di priest and Levi pipol, so dat dem go obey God kommand.


“Make yu keep di part for di ram wey bilong to Aaron and en sons and na di breast and di lap wey dem karry give God as holy ofrin.


den bring dem kom meet mi. Di priest go pour salt for dia body kon burn dem as ofrin give mi.


Make una put salt for all una korn ofrin, bikos di salt dey show di kovenant between una and God.


Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own,


E go give one part for each bread as special ofrin to God; na di priest wey take and rub di animal blood for di altar, get am.


“And dis na yor own: special ofrin wey kom from dia gift, togeda with all di peace ofrin wey Israel pipol give. I don give dem to yu and yor shidren forever. Evribody wey dey klean for yor family, go fit chop am.


God kon tell Aaron, “Si, I don put yu to kare for my special ofrin; I don give yu all di holy tins wey Israel pipol give mi as yu and yor sons own forever.


Make yu give Eleazar all of dem as special ofrin to God.


So Moses give di tax wey bi God special ofrin to Eleazar di priest, just as God kommand am.


But make una take di holy ofrin and di vow wey una make, go di place where God choose.


For der, una go karry burnt ofrin, sakrifice, vow ofrin, ordinary ofrin and una ofrin for di first fruit and animals wey una get.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ