42 Afta dem gada against Moses and Aaron, dem turn face di tent where dem for dey do meetin kon si di kloud kover am and God glory kon appear.
As Aaron dey tok to Israel pipol, dem turn look di wildaness kon si God glory wey appear inside di kloud.
For morning, una go si God glory, bikos E don hear as una dey komplain against am. Na-im una dey komplain to, nor bi wi wey just bi ordinary human being.”
God glory dey on-top Mount Sinai and di kloud kover am for six days. For di sevent day, God kon koll Moses from inside di kloud.
Moses and Aaron enter di tent and wen dem kom out, dem kon bless di pipol, den di lite wey dey shine for God present kon appear to di pipol.
But di pipol kon dey plan to stone Joshua and Kaleb. Den God lite kon appear to Israel pipol for di Tabanako.
Wen Korah gada di kommunity against Moses and Aaron for di tent door-mot, God glory kon appear to di whole kommunity.
Den Moses and Aaron stand for di tent where dem for dey do meetin.
Wota nor dey, so di pipol kon gada round Moses and Aaron
Moses and Aaron komot from di pipol front go enter di tent. Dem bow face groun and God glory kon appear to dem.