But if God do sometin wey neva happen before and di eart open swallow dem with all wetin dem get and dem die alive, den una go know sey dis men don rijet God.”
Dem nor si wetin E do to Datan and Abiram (wey Eliab wey kom from Reuben tribe, bi dia papa) wen groun open for Israel kamp kon swallow dem with dia family, dia house and evritin wey dem get.
Curse dey dia head! Bikos dem dey bihave like Kain and bikos of long-trot, dem dey do di mistake wey Balaam do. So dem go must die like Korah, wey disobey God.