Wen time rish to do di evening ofrin, Profet Elijah waka go di altar go pray, “My Oga God wey bi Abraham, Isaak and Israel God! Make Yu show today sey, na Yu bi Israel God and I bi yor savant wey dey do di tins wey Yu kommand.
Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
Naw make yu dey go; karry di pipol go di place wey I bin tell yu! Si, my angel go lead yu. Wen di day rish wen I go judge each pesin akordin to wetin e do, den I go ponish evribody for dia sin.”
Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?
Jerusalem pipol, God nor go ponish una again, instead E go take una komot from Babilon go back to una own land. But una wey kom from Edom, make una nor worry, God go ponish una, bikos of una sins.
If anybody dey plan bad for dem, fire go kom out from dia mout kon burn dia enemy finish. And if any man dey plan bad for dem, na so too E go take die.