Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 16:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Yu neva take us go any land where milk and honey full or sey yu give us where get vineyard as awa propaty. Yu tink sey yu go fit deceive us? Wi nor go kom.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 16:14
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Anybody wey allow en animals wey dey chop grass for field go chop wetin anoda man plant for en farm, e must pay back with wetin good pass for en own farm.


“For six years, make una plant and harvest wetin una plant.


But for di sevent year, una must allow di land rest and make una leave am, so dat poor pipol wey dey with una, go chop wetin grow for di land and di animals go chop wetin remain. Una must still do like dis for una vineyard and olive farm.


I don promise sey na from Egypt where una dey sofa naw, I go for take karry una go take-ova Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol land, di place where milk and honey full.” ’


I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.


So I tell una: una go stay di land and mi mysef go gi-am to una as una own; bikos milk and honey full am. Na mi bi di Oga una God and I don separate una from di odas.


Dem tell Moses, “Wi go di land wey yu send us. True-true, milk and honey full der and dis na di fruit wey dey der.


If God dey happy with us, E go take us go der kon give us dat land wey full with milk and honey.


Why yu take us komot from Egypt kom dis evil place where nor-tin dey grow? No korn, fig, grape or pomegranate fruit for here. Wota to drink sef nor even dey!”


So Filistia pipol katch am kon blind en eye, den dem tie am with bronze shain; take am go Gaza kon force am make e dey grind korn for prison.


But Nahash pipol wey bi Ammon pipol kon ansa, “Di only way wey wi fit make peace with una, na if una agri make wi blind evribody rite eye and dis go bi disgrace for Israel pipol!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ