40 Like dat, una go remember and obey my kommand kon dey holy to una God.
doz wey dey faithful to en kovenant and dey obey en kommand!
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.
Make una try to do all my kommandment. Na mi bi Oga God.
Na mi bi di Oga una God; wey take una komot from Egypt, so dat I go bi una God. Na mi bi God.’ ”
My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.
To all God pipol for Kolosse, wey bi awa brodas and sistas for Christ. Make God awa Papa give una grace and peace.
Bikos God nor koll us to live yeye life, but na to live holy life.