Bikos of dis, di Oga wey bi God for Israel sey, “Una don rijet dis message kon bilive una pawa wey bi to opress and deceive pipol. Yes! Una really love una bad karata.
Na di pesin wey sin, go die. Pikin nor go sofa, bikos of en papa sin and papa nor go sofa, bikos of en pikin sin. Pesin wey good, God go pay am for en goodness, but wiked pesin go sofa di wikedness wey e do.
If pesin dey klean and e nor travel, but e nor gri keep di Passova, make una remove am from among my pipol, bikos e nor give mi di ofrin for di rite time. E must sofa for di sin wey e kommit.
Anybody wey nor gri obey wetin di judge or di priest wey dey ripresent di Oga una God tok, una must kill dat pesin. Like dis, una go end bad and wiked tins for Israel.