Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 15:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Den di priest go do di sakrifice for di kommunity and I go forgive dem, bikos dem nor sin from dia mind and dem don bring dia ofrin; ofrin wey dem make with God fire and ofrin to klean demsef for God present, bikos of di sin wey dem nor kommit from dia mind.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 15:25
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Nor allow yor mout make yu sin and nor go defend yorsef give pastor sey, “Na mistake I take make di promise.” Dat kind tin go make God vex for yu and E fit distroy evritin wey yu don work for!


Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin. Na like dis di priest go take make sakrifice for di man for God eye.


E go do di same tin with dis melu as e bin do with di melu wey dem use for di High Priest sin ofrin. Na so e go take sakrifice for di pipol and God go forgive dem.


E go burn all di fat for di altar, just as e take burn di fat for di animal wey dem kill take do peace ofrin. Na so di priest go take do di sakrifice for di leader wey sin and God go forgi-am.


E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.


E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.


(Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.


True am, evribody wey bilive, go dey free from evritin wey Moses Law nor fit free dem from.


Na God give us Jesus Christ, so dat thru en blood, E go forgive us awa sins wen wi bilive Christ. God do dis to show sey before-before, E dey patient to forgive pipol dia sins.


Den, all di men for di town go stone di pikin die. Like dis, una go remove all di wiked pipol wey dey among una and wen evribody for Israel hear wetin happen, fear go katch dem.


So God make Christ like us wey bi en brodas and sistas. Like dis, Christ go sorry for us kon bi awa good High Priest. And bikos Christ dey koncern about God matter, e sakrifice ensef to remove awa sins.


But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.


and na en ensef bi di sakrifice wey God nid to forgive us awa sins. Nor bi only awa sin, but di sin wey di whole world dey kommit.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ