24 den if una do anytin wey nor kom from una mind and di kommunity nor know about am, di kommunity must give one yong melu as burnt ofrin to take klean demsef.
All di pipol wey kom back from Babilon bring ofrin wey dem won sakrifice give Israel God. Dem offa 12 bull for Israel pipol, 96 ram and 77 lamb; dem still offa 12 goat to klean demsef from sin. Dem burn all dis animals as sakrifice give God.
“Wen anybody disobey mi by mistake kon kommit sin as e nor obey God holy propaty, den e go bring guilt ofrin to God. Di ofrin must bi en own ram wey dey okay, or e fit use silva take buy betta one, just as dem dey measure am with di Tabanako shekel.
E go bring man sheep or goat wey dey okay kon give di priest as ofrin for en sin. Den e go measure am akordin to di Tabanako shekel. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.