Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 15:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Una go give kake from una first flower wey una grind as special ofrin, just as una do for di first korn wey una grind.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 15:20
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di bread wey wi make from di first korn wey wi harvest for each year and oda ofrin like wine, olive oil and difren kind of fruits, wi go-go give dem to di priest for di temple. Wi go give Levi pipol one out of evry ten tins wey wi get from evritin wey wi plant for awa farm, bikos na dem dey kollect am.


“Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm to di Oga una God house. “Make una nor kook yong goat wey still dey suck en mama breast.”


Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm kom di Oga una God house. Make una nor kill or chop animal wey still dey suck breast.”


Di priests go get di betta part for evry first fruit or food for Israel and evritin where Israel pipol go offa give mi. Anytime di pipol bake bread, dem must give di priests di first bread as ofrin and my blessing go dey dia house.


Una go give God ofrin from di first korn wey una harvest each year, but una nor go burn am for di altar.


“ ‘Wen una dey bring di ofrin wey una get from di first korn wey una harvest, make una give korn wey dem roast and food wey dem grind.


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen dem enter di land wey I won give dem kon harvest dia korn, make dem take di first ones wey dem harvest go give di priest.


Di priest go offa di bread and di two lamb as special gift to God. Dis ofrin dem dey holy.


Una and una shidren-shidren must give God some for di first flower wey una grind as special ofrin forever.


“I dey give yu all di best olive oil, wine, wheat and di first fruit wey Israel pipol give God.


But make una first do di good tins wey God wont and evry oda tin go bi una own.


If dem give God di first part for bread, den na God get all di bread and if dem give God tree rut, den di whole tree don bi en own too.


But God don raiz Christ from deat! And E make us dey sure sey, oda pipol go raiz-up from deat too.


Una must make sure sey una dey give God one from evry ten tin wey una get or harvest dat year.


Una go bring am kom di Oga una God present, so dat en go chop from una plant, new wine, olive oil and evry first-born for una animal. Una go bring am kom meet am for di place wey E choose sey una go for honor en name, so dat una go learn to always woship di Oga una God.


Make una celebrate Shelta Feast for seven days for di time wen una dey harvest una plant and grapes.


As God wont am, E kon born us with di true message, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.


Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ