Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 15:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Na di same law una and strenjas wey dey with una go obey forever, bikos all of una na di same for God eye;

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 15:15
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jew pipol kon make law for demsef, dia shidren-shidren and any oda pesin wey go turn to Jew sey, for di rite time for evry year, dem must observe dis two days akordin to wetin Mordekai rite.


Una go dey remember dis day and celebrate am to di Oga una God forever.


“Una and una shidren must kontinue to obey dis law forever.


So God tell Moses and Aaron, “Dis na di law wey follow di Passova. No strenja go chop from di Passova food.


Anybody, weda dem born as Israel pesin or strenja wey dey stay with una, must obey dis law.”


Aaron and en sons must wear am anytime dem enter di tent where dem for dey do meetin or wen dem dey go serve for di Most Holy Place for di altar, so dat dem nor go die, bikos of any sin. Dis kommandment na for Aaron and en shidren-shidren forever.”


Dis law na for all of una, weda yu bi Israel pesin or strenja. Na mi bi di Oga una God.”


“Na only di priests wey bi Aaron shidren-shidren must blow di trumpet. Dis law na forever and una must obey am from one generashon go rish anoda.


And if strenja dey stay among una, weda na for sometaim or forever and dem won offa ofrin wey get sweet smell to God, dem must follow di rules and regulashon.


Una must get one law for di pesin wey nor kommit sin from en mind, both for Israel pipol and di strenjas wey dey stay with una.


God kon tell Aaron, “Si, I don put yu to kare for my special ofrin; I don give yu all di holy tins wey Israel pipol give mi as yu and yor sons own forever.


“ ‘If strenja wey dey with una won keep di Passova, dem must do am akordin to all di rules and law. Na di same law di strenja and una own pipol go obey.’ ”


E nor matter weda una bi Jew or Greek pipol, savant or free pesin, man or woman, bikos all of una dey inside one body for Christ.


For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.


Di pipol, rulers, leaders and judge dem stand for di two side for di box and for di Levi priests wey karry God Kovenant Box. Both Israel pipol and doz wey dey der as strenjas dey for di box front. Half of di pipol stand for Mount Gerizim front and di oda half stand for Mount Ebal front, just as God savant Moses kommand dem to do, before dem kollect di blessing.


David make dis law and Israel pipol dey obey dis law kon rish today.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ