Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 14:43 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

43 bikos Amalek and Kanaan pipol dey wait una and dem go kill una well-well. Bikos una don turn from God, E nor go-go with una.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 14:43
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.


Yu make us run from awa enemies kon allow pipol wey hate us, pak awa propaty.


but dem fight against am kon make am vex. So God kon bi dia enemy and E fight against dem too.


Even if dem born, I go kill di pikin. Bad-bad tins go happen to dis pipol wen I don leave dem.”


I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.


Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”


(Naw Amalek and Kanaan pipol dey stay for di valley.) Tumoro, make una turn back kon travel go di wildaness for di road wey dey near di Red Sea.”


Make una nor go, bikos God nor dey with una and una enemies go win una,


But dem still go di kountry on-top di hill, even doh God Kovenant Box and Moses nor dey with dem.


God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.


Dem kon go Gilead land go meet Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon tell dem:


Israel pipol nor fit stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to una.


Den e shaut, “Samson! Filistia pipol don kon katch yu!” E wake-up kon tell ensef, “I go do as I dey do before, I go shake mysef and dey free.” E nor know sey Oga God don leave am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ