God Spirit kon enter Zekaraya wey bi Jehoiada pikin. E stand up kon tell di pipol, “Dis na wetin God tok: ‘Why una nor dey obey God kommand? Una nor go prosper and God don rijet una, bikos una nor gri obey am!’ ”
Una go kover una face with shame and sorrow wen una dey kom back from Egypt, bikos God don rijet di pipol wey una trust and even with dia help, e nor go still betta for una.”
Dem go take Zedekaya go Babilon and e go stay der until I don deal with am finish. Even if e fight Babilon pipol, e nor go win. Mi, wey bi God, don tok.’ ”