40 Early di next morning, dem start to travel go di hill kountries kon sey, “Naw wi don ready to go di place wey God don dey tell us. Wi know sey wi don sin.”
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
Balaam kon tell God angel, “I don sin. I nor know sey yu stand against mi for di road. So if wetin I dey won go do nor dey good for yor eye, I go-go house back.”
If di Oga God wey get di house go lock di door, una go stand for outside dey nok and beg sey, ‘Oga God, make yu let us enter!’ “But e go ansa, ‘I nor know where una from kom.’
Den una ansa mi, “Wi don really sin against God. Naw, wi dey ready to fight doz pipol, just as awa Oga God don kommand.” So each of una wear una war klot kon ready to go fight.