Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 14:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Wetin make God bring us kom dis land, so dat dem go kill us for war? Dem go katch awa wifes and shidren go as slaves! E for betta sey wi go Egypt back o-o?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 14:3
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem nor gri obey; dem forget all wetin Yu don do; dem forget di mirakles wey Yu do and bikos of dia pride, dem choose leaders wey take dem go back to Egypt as slave. But Yu bi God wey dey forgive. Yu dey good and dey sorry for pesin. Yu nor dey kwik vex and yor royal love nor dey fail. Yu nor abandon dem at-all


Dem sin against am many times for di wildaness kon make am vex for dat dry dirty land.


Dem sey, “E for betta sey God kill us for Egypt, bikos wi even dey si food chop for der, but naw, E take us kom dis wildaness won kon kill us with honga!”


sey, “Make God judge una, bikos una don make di king and en workers hate us and una don give dem shance to kill us!”


Make una nor sey, ‘No! E betta make wi go Egypt instead of us to stay dis land, bikos for der, wi go dey free from war and food plenty for der wey wi go chop.’


“I still tell dem, ‘God don tell una wey remain for Judah sey make una nor go Egypt.’ So I dey warn una,


God sey, “Dis pipol bi like sojas wey don ready dia bows. Dem always dey ready to lie, bikos of dis, dem don get pawa for di land, but na wayo dem take get am. Dem don do many bad tins and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.


but na for one full mont. Una go chop am until meat go kom out from una nose kon make una dey sick, bikos una rijet God wey dey among una kon dey komplain sey, ‘Wi nor for komot from Egypt o-o.’ ”


Di one wey yu take us komot from Egypt wey get milk and honey neva rish yu? Yu still won kill us for di wildaness as yu dey trit us like yor savant?


dey komplain sey: “E for betta sey all of us die for di tent for God present!


Di pipol tok against God and Moses sey, “Why Yu take us komot from Egypt make wi for die for dis wildaness wey bread or wota nor dey and wi don taya for dis yeye food.”


But una papa nor gri obey am. Instead, dem nor ansa am, but dem shange dia mind sey dem won go Egypt back.


Una shidren wey una feel sey go die for road, di ones wey nor know good from bad, na dem I go give di land to. I go give dem di land and e go bi dia own forever.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ