Just as star many for sky, na so di shidren wey Yu give dem many and Yu let dem win and stay for di land wey Yu promise dia grand-grand papa sey Yu go give dem.
‘Bikos dem nor follow mi with all dia heart, no one among dem from twenty years go wey komot from Egypt go si di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob,
Look! I don already give di land to una. So make una go kollect di land wey mi God promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob and dia shidren.”
Na only wi wey bilive go fit enter di place where God rest dey, bikos God sey, “I vex kon swear for dem, so ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey!’ ”