kon sey, “My Oga God, if I really dey good for yor eye, make Yu go with us, bikos wi bi sturbon pipol; make Yu forgive us awa evil and sin kon take us as yor pipol.”
Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
For my vishon, I si di lokust dey chop all di plant wey dey grow for di land, so I sey, “God wey get pawa, I beg, make Yu forgive us; wi nor go survive dis wahala bikos wi nor plenty and wi weak well-well.”
Den e kon dey komplain to God, “My God, before I komot from my kountry, I know sey dis na wetin Yu go do? Na dis tin make mi try to run go Tarshish! I know sey Yu dey sorry and kare for pipol and Yu get patient, dey kind and instead of Yu to ponish pipol, Yu always dey ready to forgive dem.
E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.
My God, I don hear evritin wey Yu do and e sopraiz mi well-well. Even naw for awa time, make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before. Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.