30 Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”
But with awa God help, wi go get viktory, bikos E go help us mash awa enemies for groun kon win dem.
Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”
But di men wey go with Kaleb kon sey, “No, wi nor strong rish to fight dem; di pipol wey dey der get pawa pass us.”
But bikos my savant Kaleb nor bihave like di oda men and bikos e obey mi, I go take am go di land wey e go spy and en shidren-shidren go stay der.
Di men wey Moses pick from each tribe, na dia names bi dis: from Judah tribe, e pick Kaleb wey Jefunneh born;
Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?
Inside all dis tins, awa joy don dey full, bikos Jesus love us!
I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa.
na faith dem take win kingdoms; do wetin good for God eye; kon get di tins wey God promise dem; klose lion mout;